Faragon Series: Agbero Palava

Catch up on the last episode here.

Synopsis of issue #2:

How far my country poeple I hail una o! How tinz for una side? My Lagos people una tuale o!

My na solo, I be bus conductor for Lagos, and everything dey go wella for me until last two month wey one big kasala burst for my side … Omo no be small thing o.

The tin hit me so tey e touch my family and friends self. After I don solve the problem and everithing don die down, na him I come dey think am say he go better make I share dis tory with una wey dey read this book now, so dat una go fit learn from wetin happen. But if una must to enjoy the tori, I must talk am from the starting.

Although I don turn confirm Lagos guy, no be Lagos dem born me. No be even Lagos I grow up. Na my friend Ejiro invite me come Lagos make I come work. Na this work I dey work befor the gbege come happen. Before I tell una about the gbege, make I yarn am from when I reach Lagos … Na my tori be this

FARAGON_ELUKU FARAGON-BLOG

Leave a reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

cool good eh love2 cute confused notgood numb disgusting fail